fbpx
March 19, 2024

EPL: Mourinho no gree sign Virgil van Dijk for Man United – Kamara don open up

kamara-don-open-up-say-hin-advise-Jose-Mourinho-to-sign-Virgil-van-Dijk

Popular British presenter, Chris Kamara don open up say he don advise Jose Mourinho before say make hin sign Virgil van Dijk for Manchester United.

Liverpool win di race to sign Van Dijk, a top defender, for January 2018 for deal wey worth £75m and e don prove to be money well spent.

Di Netherlands international go on to establish himself as one of di best defenders for di  English top flight and for di world.

Hin don help di Reds win several titles, including di Premier League and Champions League.

And former Sky Sports reporter Kamara yarn say he advise di former Chelsea, Real Madrid, Inter Milan boss, Jose Mourinho make he sign Van Dijk from Southamton during hin reign at Manchester United and e appear say di Portuguese boss dey interested in a deal.

Kamara yarn say di legendary manager, Mourinho tok say Manchester United no wan spend dat kain money to sign Van Dijk.

 

You fit go read di tori…READ MORE