fbpx
May 5, 2024

Ex-lawmaker, Bimbo Daramola don return to APC

ex-lawmaker-daramola-return-to-apc

Di former member of di House of Representatives wey represent Ekiti North Federal Constituency 1, also Ex-lawmaker Mr Bimbo Daramola, don return to di All Progressives Congress, APC, with some of hin followers.

Bimbo Daramola bin comot for hin party few years ago and hin join di Social Democratic Party, SDP.

However, Daramola don reconsider hin step after hin meet with di incumbent Governor of Ekiti State, Biodun Oyebanji,for di Government House wey dey Ado Ekiti a few months ago.

State Chairman, Barrister Paul Omotosho of APC welcome Daramola for di Iree Ward 2, and other leaders of di party, wey express happiness over hin return.

 

FOR MORE NEWS: Ministerial list: Wike go comot for PDP – Ex-minister Bio

 

Barrister Omotosho yarn say di party feel di absence of Daramola, also, hin yarn say di history of di APC no go complete without am.

In addition, he yarn say di party beg am to return because hin be one of di few leaders wey sacrifice everything for di growth of di party.

For hin remark, Bimbo Daramola express happiness for reuniting with hin people and hin promise to continue to support di growth and development of di party.

Also, hin appreciate di leaders of di party and hin confirm am say hin dey always use hin positions and influence to give back to hin pipo.

You fit go read di tori as Ex-lawmaker Daramola don return to APC…READ MORE