fbpx
May 5, 2024

Ministerial list: Wike go comot for PDP – Ex-minister Bio

ministerial-list-wike-go-comot-for-pdp-ex-minister-bio

Ibrahim Bio, wey be former Minister of Transportation, yarn say e dey clear say di former governor of Rivers State, Nyesom Wike, go soon comot for PDP, Peoples Democratic Party.

Bio reveal dis tori on Thursday during interview on top Arise Television as hin dey react to Wike ministerial nomination by President Bola Ahmed Tinubu.

According to Bio, e dey vident say Wike go soon exit PDP because hin no fit marry leadership position of di PDP for Rivers State and minister under di All Progressives Congress-led administration.

 

FOR MORE NEWS: Oluwo to Tinubu: No coup must survive under your watch

 

Hin yarn say Nyesom Wike na di only PDP card-carrying member on di ministerial list.

On top di matter, he yarn say hin no know how Wike wan marry di leader of PDP for Rivers State.

“It is apparent that Wike is on his way out of PDP”, Na wetin hin tok be dat.

According to report, Wike, three former governors and 24 other nominees make Tinubu ministerial list wey Senate President, Godswill Akpabio read for di plenary on Thursday.

You fit go read di tori see why Bio yarn say Wike go soon comot for PDP…READ MORE