fbpx
May 19, 2024

Cross River govt don suspend ‘quack pharmacists’

cross-river-government-suspend-pharmacy-vendors

Commissioner for health for Cross River State, Dr Henry Egbe Ayuk don suspend vendors wey dey run pharmacy for di State General Hospital, hin describe dem quacks.

He yarn say di quack pharmacy don contribute to di degree of anomalies wey dey trouble hospitals. Hin add say for over one year dem neva do any remittance to di State coffers.

Ayuk take di action when hin paid unplanned visit to di hospital on Monday evening. Also, hin lament about di lack of qualified personnel.

In addition, hin yarn say di pipo wey dey manage di pharmacy no dey qualified. Also, dem no get any background in pharmacy.

 

FOR MORE NEWS: NANS go shut down Akure over death of FUTA 500-level student

 

Hin tok say as far as hin dey concerned, dat place na quack shop because e no get di required personnel.

Also, hin ask say how person wan take ensure quality assurance when better pharmacy technicians no dey, and na dat one be di minimum requirement for such services.

Accordingly, hin tok say hin don direct say dem need to review of di memorandum of understanding.

Di Health Commissioner follow appeal to di pipo wey dey in charge of laboratories say make dem block revenue leakages through accountability.

You fit go read di tori see why Cross River government suspend pharmacy vendors…READ MORE