fbpx
May 7, 2024

Nigerian pharmacist share sad story of colleague wey kpai because of power outage

nigerian-pharmacist-share-sad-story-of-colleague-wey-kpai-because-light-no-dey-

One Nigerian pharmacist don share di sad story of how dia colleague on life support kpai after di hospital suffer power outage wey last for more than 24 hours. Di Nigerian pharmacist dey identified as Subpharmacy.

According to am, di colleague wey die bin get accident and di accident cause  “blood clots” for hin brain. Na wetin make dem give am oxygen for di ICU, but PHCN kon take light.

As light no kon dey for long, di man no kon get air supply, because of di situation, hin no fit breathe on hin own.

FOR MORE NEWS: Obi Cubana support for Portable music don bring reactions from social media users

Di Nigerian pharmacist share sad story of when hin mama bin dey admitted for one hospital like that, she almost suffer di same fate two years back but hin go hin houe bring hin personal gen wey dey use power her ward.

Hin tok say di gentlemen packed up as dem take light, and di man follow be pharmacist wey get wife and children.

Di pharmacy yarn say hin wish say di story no be true story.

You fit go see di full tori…READ MORE