fbpx
April 27, 2024

FG go fix date for national census – NPC

fg-date-for-national-census

Di National Population Commission (NPC), don tok say dem go fix new date for National Census, and na FG, Federal Government go fix am.

NPC yarn say dia focus na to make sure say all resources wey dem spend dey safeguarded ahead of di 2023 Population and Housing Census for di kontri.

Mr Darlington Okereke, NPC Federal Commissioner for Ebonyi, tok dis one for one-day Breakfast Meeting for Media Executives on Friday for Abakaliki.

 

FOR MORE NEWS: Federal High Court don go on annual vacation July 24

 

Okereke yarn say safeguard dey necessary to avoid starting preparations all over when dem fix new date.

Di Commissioner tok say den don carry out all di preparatory activities towards di census exercise, including di Enumeration Area Demarcation (EAD) and conduct of pre-tests and trial census amongst others.

You fit go read di tori of FG date for national census…READ MORE