fbpx
May 3, 2024

Actor, Federick Leonard under fire for reacting to Yul Edochie second wife, Judy Austin post

frederick-react-to-judy-post-netizens-don-call-am-out

Nollywood actor, Frederick Leonard, don stir reactions online after hin react to post wey actor Yul Edochie second wife, Judy Austin share on top instagram.

Judy, wey netizens don ‘cancel’ on top social media due to her marriage to di actor, she share behind-the-scene visuals from movie set. Inside di video, dey capture her as she dey lead her crew member in prayer session.

Dis one dey come after Judy reveal say she dey work on one film alongside her husband and other Nollywood stars like as Ngozi Ezeonu, Ebele Okaro, and Sarah Martins.

 

FOR MORE NEWS: “I need to sue this guy” – Iyabo Ojo dey vex after Dacoster recreate her N37.5million AMVCA dress

 

In reaction, Frederick only like di post and hin no even leave comment but hin like no go unnoticed by netizens wey  start to tag hin wife, actress Peggy Ovire, to call am to order.

Di trolls lambast di actor for interacting with di post of woman wey “snatch” her fellow woman husband. Also, dem warn am make hin stay away from Yul Edochie family saga.

Following di call-out, Freddie no get choice but to unlike di post.

You fit go read di tori see reactions as Frederick react to Judy post…READ MORE