fbpx
May 14, 2024

I dey face war to become Senate President – Akpabio

akpabio-appeal-for-prayers

Di Senate President aspirant for di 10th National Assembly, Senator Godswill Akpabio, don appeal for prayers, hin yarn say war dey out there for am.

Akpabio tok dis one during hin speech when he meet with di APC Non-Serving Senators Group for Abuja on Tuesday.

Also, hin promise say di 10th Senate go collaborate with di President-elect, Bola Tinubu to pay off di nation debts.

“I am excited that God is keeping all of you alive. This is a family and I am very proud to belong to this family. “I want to also appeal that you not only endorse us but support us with your prayers because what I am seeing out there is that it is a war. But I see it as a storm in a teacup,” Na wetin Akpabio tok be dat.

 

FOR MORE NEWS: US State Secretary, Blinken call Tinubu ahead of May 29 inauguration

 

Di APC don zoned di Senate Presidency to Akpabio, Deputy Senate President Barau Jibrin (Kano), House of Representatives Speaker Abass Tajudeen (Kaduna) and Deputy Speaker Ben Kalu (Abia).

You fit go read di tori as Akpabio appeal for prayers…READ MORE