fbpx
December 22, 2024

Fuel: Mass supply go start for Lagos and three others for January

Fuel-supply-

A special joint arrangement by di Nigerian National Petroleum Company Limited and 30,000-member independent petroleum marketers go lead to mass supplies of Premium Motor Spirit,  petrol for Lagos, Calabar, Port Harcourt and Ogara from next month.

Di move na part of di arrangement by di government and stakeholdersfor di fuel supply chain to find permanent solution to di fuel scarcity for di country.

Officials confirmed on Sunday say di NNPC Limited and di Independent Petroleum Marketers Association of Nigeria don agree and dem select Lagos, Port Harourt, Calabar and Ogara as four major fuel supply points from where di product go move to other parts of di country by IPMAN members of di independent.

Di fuel supply gap across di country don lead to queues for filling stations with motorists wey dey complain say dem no fit access di product, especially for di regulated pump price of N180/litre.

You go like go read di full tori…READ MORE