fbpx
May 6, 2024

Fuel scarcity fit show for Lagos

fuel-scarcity-fit-show-for-lagos

For Lagos state, wahala don burst on Tuesday, February 20, as motor people begin form long queues outside filling stations because of scarcity of fuel. Dis one come happen based on say National Association of Road Transport Owners (NARTO) give directive say make petrol tankers stop to dey work.

Di koko be say, plenty filling stations for areas like Apapa to Oshodi, Agege to Oshodi, Mushin to Idioro, Oshodi to Berger and others, dem no dey open for business. Na only one M.O.J filling station for Bolade, Oshodi dey attend to people.

People wey dey Agege come dey vex as transport fares don high from N300, N400 reach N600-N700 sake of di fuel scarcity. Some people sef just decide to trek go Oshodi instead of paying di high transport money.

 

FOR MORE NEWS: BREAKING: Exchange rate for cargo clearance don hit N1,605 per dollar.

 

NARTO bin write letter to Federal Government and Major Energy Marketers Association of Nigeria on February 15, 2024, to talk say dem wan suspend operations because di cost wey dem dey spend pass wetin dem dey make, and say di economy no dey stable. Dem come park dia trucks on February 19, and di wahala worsen.

Some filling stations like NNPC for Akowonjo sell petrol for N580 per litre, while Mobile for Mushin-Oshodi road sell for N599. Technoil for Isolo Bus Stop no get petrol at all because no tanker dey to bring am come.

As we dey so, people just dey pray make di fuel scarcity no too tey so e no go make di matter wey people dey face worse pass wetin e be.

You fit go read read di tori of Lagos fuel scarcity…READ MORE