fbpx
May 5, 2024

Nursing student commit suicide sake of unwanted belle

300-level-student-kpai

Wahala burst as one 300-level student for one private school for Abeokuta, Ogun State, wey dem just call Ajoke, don kpai.

Dem talk say Ajoke, wey be student for Basic Medical Science for Havarde College of Science, Business and Management Studies, Abeokuta, drink poisonous substance wey dem suspect say na Sniper on Monday evening for her hostel room wey dey off-campus.

People wey sabi for di school talk say di girl wey don dey battle depression, fit don kill herself sake of unwanted belle. Another tori talk say her condition worsen when she find out say di course wey she dey study never get accreditation from di Nursing and Midwifery Council of Nigeria.

 

FOR MORE NEWS: Fuel scarcity fit show for Lagos

 

But di school provost, Dr. Ismail Oyetunji, talk say di matter wey lead to di girl death happen outside di school premises. E add say di girl parents come pack her load from di school last week. Dis na after dem find out say she get belle.

E say, “A 300-level nursing student was reported to me this morning by our dean of students affair to have committed suicide. She was impregnated by her boyfriend. Her parent got to know and came last week to pack her belongings from the school.”

Meanwhile, di Ogun State Government don shut down di Nursing Department of di school.  Dis na sake of say dem dey offer Nursing Sciences degree programme wey no get accreditation from di Nursing and Midwifery Council of Nigeria. Na so officials of di state Ministry of Health and members of di State Nursing and Midwifery Committee (SNMC) carry out di enforcement exercise.

Dem talk say di Nursing Department go remain close until dem get full accreditation from di NMCN.

You fit go read di tori see why 300-level student Ajoke Kpai…READ MORE