fbpx
May 19, 2024

300-level FUTA student don commit suicide because of fraud allegation

futa-student-commit-suicide-because-of-suicide-allegation

One 300-level FUTA student don commit suicide because of fraud allegation. This sad news happen for di Federal University of Technology Akure. Di name of di student na Olona Oluwapelumi. Hin commit di suicide for hin house for  Aule Area of Akure, di Ondo State capital.

This student wey die dey popular with di name Black. Hin bin dey di Department of Industrial Design for di university. Di deceased commit suicide by hanging himself inside hin room.

As at di time wey dem file this report, nobody know di reason why di 300-level FUTA student commit suicide.

One source for di school explain how dem find out wetin happen. Hin tok say di as di friend go check am for hin room, dem find out say di room dey locked. Dem knock tie but nobody answer, na so dem break di door.

Di state Police Public Relations Officer, Mrs Funmilayo Odunlami, confam di death of di 300-level student and she tok say di incident dey reported to police already.

She tok say dem don carry di body go mortuary and dem don start investigation o that dem go fit know di reasons behind hin action. But di way wey dem see am, na suicide,

Di Students Union Government of di school for inside statement,wey dia President,  Jesunifemi Asoore sign, follow confam di incident.

When dem contact di Head of Media and Protocols Unit of di institution, Mr Adegbenro Adebanjo, He follow confam di incident.

Dem don send message to di family of di deceased.

You fit go read di full tori…READ MORE