fbpx
May 19, 2024

University dean don kpai, Wetin kill am? Na auto crash for Bayelsa

university-dean-don-kpai-wetin-kill-am

Di University Dean of Student Affairs for Bayelsa State-owned Niger Delta University, NDU, Dr. Ayasen Kemeakigha don kpai. Hin burn to death for inside lone car accident wey happen along di popular Tombia Amasomma Road. When di incident happn, hin bin don comot for di di institution dey go Yenagoa, di capital of di state on Saturday, January 21.

 

A statement by di Bayelsa State Police Command Public Relations Officer, SP Asinim Butswat, confam di incident and he note say di deceased be di only person wey dey inside di car.

University-dean-auto-crash-in-Bayelsa

FOR MORE NEWS: 300-level FUTA student don commit suicide because of fraud allegation

“On 21st January 2023 at about 14:45 hours policemen respond to di scene of  lone fatal car accident along Tombia-Amassoma Road, Bayelsa State, and dem discover say di only person wey dey di vehicle, one Toyota Corrolla with Reg. N0. 06H 132 BY di person and di car bin don burn..

Upon inquiries, e dey revealed say di deceased na Dr Ayasen Kemeakegha, 55, di university Dean of Student Affairs of di Niger Delta University, Amassoma. Dem don carry di body go morgue now. Investigation still dey go on.

 

Di institution neva comment on this development of di university dean wey don kpai.

You fit go read di full to tori…READ MORE