fbpx
May 5, 2024

G-5 no endorse Atiku, ignore fake report – Gov Ortom

G-5-no-endorse-Atiku.

Benue State Government yarn say di report wey dey spread online no be true, G-5 no endorse Atiku. Hin claim say di Governor, Samuel Ortom and hin counterparts for di G-5 don decide to work for di presidential candidate of di Peoples Democratic Party, PDP, Alhaji Atiku Abubakar, so that hin go win di 2023 election.

Hin still yarn say make pipo no mind di report wey dey spread online.

This statement dey signed by Special Adviser, Media and Publicity to di Governor, Terver Akase, on Tuesday.

FOR MORE NEWS: Election dey face serious threat of cancellation – INEC

According to di statement, di report na bad one and no be true. Writers wey dey spread am wan embarrass di five Governors wey don chose di path of justice, fairness and equity.

As dem dey manifacture di report, dem dey on mission to score a cheap political point. Di report no mention di place and date of di meeting of G-5 Governors wey dem dey tok.

Di writers wan take advantage of di problem within di PDP for dia selfish purposes. Governor Ortom and other members of di G-5 no endorse Atiku.

You go like read di full tori…READ MORE