fbpx
May 2, 2024

Election go hold as scheduled, Buhari don tok

Election-go-hold-as-scheduled-Buhari

President Muhammadu Buhari don tell Nigerians say di forthcoming election go hold as dem don plan am already. Di president drop this update as hin dey receivie di executive members of di Catholic Bishops’ Conference of Nigeria (CBCN) for State House, Abuja.

Pipo bin dey tok different thing after di Independent National Electoral Commission (INEC) bin yarn say election for this year fit no happen because of insecurity threats. Na on Monday INEC bin drop that update.

FOR MORE NEWS: 200,000 out-of-school children back to school for Sokoto

Dem say this year general elections dey face threat of cancellation and postponement if insecurity for some parts of di country no dey addressed.

One source wey follow attend di meeting yarn say di president assure clerics say di election go hold as INEC dem don plan am.

President Buhari take say di security situation don improve over di years, especially for North East where dia focus now na to rebuild infrastructure and re-orientation on education.

You go like go read di full tori…READ MORE