fbpx
May 2, 2024

Ganduje don sack one of hin commissioner

Governor Abdullahi Umar Ganduje of Kano State on Saturday don sack di Commissioner for Religious Affairs, Dr. Muhammad Tahar Adam (Baba Impossible).

Di governor sack di Commissioner base on say hin no dey loyal to di government.

U FIT ALSO READ INEC – Almost 1.7 million PVCs still dey our office for Lagos

Ganduje inside one statement by di state commissioner on information and internal affairs, Muhammad Garba, hin tok say dey don relieve di commissioner from hin appointment with immediate effect.

According to di statement, “ Sacking of di commissioner wey bi member of di state executive council happun base on di kind attitude towards public service as a public servant wey dey hold a sensitive office, as well as bad utterances.

Report tok say hin dey run di affair of hin office as personal business and hin reduce working days for di staff of di ministry, by exempting Wednesdays and Fridays.

Apart from say hin dey operate without due consultation, hin tok say Baba Impossible no dey loyal at all at all to di government”.

To read di full tori CLICKHERE