fbpx
May 2, 2024

Water scarcity: Obasanjo, Daniel don strike business deal for Ogun

Water-Scarcity-Obasanjo-Daniel-

Former President Olusegun Obasanjo and a former governor of Ogun State, Gbenga Daniel, don agree to join hand provide potable water for dia businesses for Abeokuta.

Water scarcity be major problem for plenty parts of Abeokuta, because of di rocky nature of di ancient city.

Obasanjo, di owner of di Olusegun Obasanjo Presidential Library (OOPL) and Daniel, di founder of Conference Hotel have don strike deal to solve di water challenges wey dia companies dey face.

FOR MORE NEWS: Ganduje don sack one of hin commissioner

Di two organisations dey opposite each other for Okemosan area of Abeokuta.

Obasanjo wey tok on Saturday for di commissioning of a 1.5million-litre water project for OOPL,yarn say he decide to strike business deal with Daniel Conference Hotel on water after hin intervention for di power challenges.

Di former President yarfn say na solar power hin settle for and hin create dam within di complex of di OOPL with a view to provide clean water for di facilities.

You fit go read di full tori…READ MORE