fbpx
May 18, 2024

Musa, Ebi snub Osimhen, Oshoala for FIFA awards

Musa-snub-osimhen-oshoala-for-fifa-awards

According to reports, truths don come out about how coaches and captains of Nigeria senior national teams and a representative of di Nigerian media no vote for compatriots Victor Osimhen and Asisat Oshoala for di FIFA Best Football Awards despite dia fine performances for 2022.

Di best FIFA Football Awards 2022 ceremony wey dem hold for Paris on Monday see Alexia Putellas, Oshoala’s Barca Feminin teammate, and Lionel Messi crowned as di outstanding players of di past year.

Also, di award dey determined by votes from national team captains and coaches, journalists and fans.

Following di Awards ceremony, FIFA publish how each captain and coach vote, with Super Eagles captain Ahmed Musa wey no vote for Osimhen and hin Super Falcons counterpart Onome Ebi overlook Oshoala for her voting.

FOR MORE NEWS: British Columbia first in Canada go provide free contraceptives

Osimhen dey outstanding for both club and country for di year under review (2022) but hin nonget any vote for hin form, like other nominees get from dia respective captains and coaches.

He score 20 goals for Napoli for 2022 and also win di ‘Emerging Player of di Year’for di Globe Soccer Awards. Hin beat Barcelona and Real Madrid’s midfielders Gavi and Federico Valverde to di honour.

Oshoala, on her part, win di Pichichi award, di prize for di top scorer for di Spanish league.

Also, di five-time African Women Player of di Year score 20 goals for 19 games for Barcelona Femeni in 2022 to finish joint-top scorer for di Spanish topflight despite say she miss two months through injury.

You fit go read di full tori…READ MORE