fbpx
May 9, 2024

Germany, France oppose push to extend Ukraine grain curbs

germany-oppose-grain-exports

European Union heavyweights Germany and France on Tuesday oppose a push to extend restrictions on sales of Ukrainian grain exports in five eastern European kontries wey don make Kyiv dey vex.

EU kontries along di border of di global agricultural powerhouse start to bar imports after dia farmers protest say Ukrainian grain dey push down prices.

Also, Brussels struck settlement in April allow Bulgaria, Hungary, Poland, Romania and Slovakia to prohibit sales on dia local markets. However, dem keep transit routes open for Ukrainian grain to cross dia territories.

 

FOR MORE NEWS: Obama family private chef don drown

 

In addition, di measures dey set to run out in mid-September, but di five kontries don call say make e dey prolonged to di end of di year.

Ukraine President Volodymyr Zelensky on Monday brand any extension “absolutely unacceptable and frankly anti-European”.

Hin broadside come as di focus settle on securing routes for Ukraine to export grain to global markets after Russia withdraw from deal to send am via di Black Sea.

Also, Kyiv opposition bin dey echoed by EU kontries including Germany and France for meeting of di bloc’s agricultural ministers for Brussels on Tuesday.

German agriculture minister Cem Ozdemir yarn say di European Commission, di EU executive arm, need to make am clear say any extension no go dey possible”.

You fit go read di tori see why Germany oppose grain exports extention…READ MORE