fbpx
April 29, 2024

My boss dey recuperating well – Ondo Ag Gov

governor-akeredolu-dey-recuperate

Di Ondo State Acting Governor, Mr Lucky Aiyedatiwa, yarn say hin dey in constant touch with Gov. Oluwarotimi Akeredolu, wey dey recuperate for hospital abroad.

Aiyedatiwa tok dis tori on Tuesday for Akure,  dis na as hin react to some media reports wey hin tag: ‘faceless writers to fan ember of unity for di state.

Di acting governor encourage di general public, to as usual, ignore di unfortunate lies and deception as di antics of desperate political gladiators across political divides.

Also, hin yarn say di governor appreciate pipo prayers and good wishes for am and di State, across board. Hin dey high in spirit, hin dey recuperat and hin go return back in office to continue with hin laudable service to di State, as soon as hin dey certified medically fit by hin Doctors.

 

FOR MORE NEWS: 2023 polls aftermath: PDP face survival threat

 

In addition, di acting governor tok say di tactics of di faceless writers and agents of provocateurs na to tarnish di hard earned reputations of individuals for government circles and distract Government attention for selfish politic gains.

Also, di deputy governor tok say di state government no go go back on hin promise for di important obligation to di people. And, hin encourage pipo make dem continue to dey law-abiding, peaceful and endeavour to pursue legitimate businesses and activities unhindered.

You fit go read di tori, Governor Akeredolu dey recuperate…READ MORE