fbpx
April 28, 2024

Jigawa : Governor Namadi Swear-In 16 Commissioners

governor-namadi-swear-in-commissioners

Jigawa State governor Malam Umar Namadi don swear-in 16 commissioners to constitute hin executive council members, and hin charge dem to work on principles of public trust, probity, accountability and fear of Allah.

Di new commissioners dey sworn in after dia nomination by di governor and screened by di State House of Assembly.

Speaking shortly after administrating di oath of office and designating ministries to di commissioners, Governor  Namadi tok say all di commissioners dey carefully selected based on dia track record of integrity, dedication, professionalism and selfless service to humanity.

“As a new governor I need competent and capable hands who can help me in fulfilling campaign promises and take Jigawa to great heights. And God in His infinite mercy and wisdom choose you, please, don’t let me down. Na wetin hin tok be dat.

 

FOR MORE NEWS: JUST-IN: Actress Cynthia Okereke don kpai

 

Also, hin remind di commissioners say public service na public trust, and hin add say hin no go tolerate any breach of that trust.

In addition, hin note am say Jigawa pipo dey expect hin administration to come up with policies and programmes wey go improve dia socio-economic life. Also, hin tok say dem go only achieve am by discharging dia responsibilities on di principles of accountability, probity, loyalty and prudent management of public resources.

You fit go read di tori as Governor Namadi Swear-In Commissioners …READ MORE