fbpx
April 29, 2024

Presidential election: No cancel our victory over 25 percent for FCT – Tinubu, Shettima dey beg tribunal

Tinubu-and-Shettima-beg-tribunal

President Bola Tinubu and Vice President Kashim Shettima, don beg di Presidential Election Petition Tribunal make dem no nullify di February 25 presidential poll.

Tinubu and Shettima yarn say make di tribunal no cancel di presidential election over di controversy surrounding di 25 percent for di Federal Capital Territory, FCT.

Dis na as dem encourage tribunal to dismiss di petition of di Labour Party, LP, and dia presidential candidate, Peter Obi. Also, dia appeal dey contained inside final address by dia lead counsel, Wole Olanipekun.

Inside di address, Olanipekun describe di arguments and testimonies of witnesses presented by the challengers as “frivolous, bogus and based on hearsay.”

 

FOR MORE NEWS: N8,000 palliatives na insult to poor Nigerians – Kenneth Okonkwo

 

Also, he suggest to di court say make dem dismiss di petition because e no lacked merit and substance.

Hin stress say di “remote” contention of di petitioners no dey backed by any fact wey law know. Di petitioners dey ask tribunal make dem cancel Tinubu and Shettima election. And, dis na because dem no score 25 percent or one-quarter of di votes wey dey recorded for di FCT

In addition, hin yarn say di Judges no fit perform miracles in di handling of civil claims, and at least of all manufacture evidence just because he wan help plaintiff win hin case.

You fit go read di tori see as Tinubu and Shettima beg tribunal…READ MORE