fbpx
April 26, 2024

Governorship Election: Live Updates, Results from 28 States

governorship-elections-today-live-updates

Di Governorship and State Houses of Assembly Elections go hold across di Kontri today, Saturday, March 18, 2023.

Also, di Governorship election go take place for 28 States across di nation with just a few Governors wey dey seek re-election while most of di States go elect new chief Executive Officers.

For Lagos, Babajide Sanwo-Olu dey seek reelection on di platform of di All Progressives Congress, APC, while di Peoples Democratic Party, PDP, nominate Abdul-Azeez Olajide Adediran as dia candidate and dem go battle Gbadebo Rhodes-Vivour of di Labour Party.

Two major political parties, di PDP and APC, get most candidates for Saturday election but go get more work to win for some states where di Labour Party get candidates.

Voting don start for Anambra State for di House of Assembly elections.

Report yarn say within Awka, di state capital, voting don start as early as 8:30am.

FOR MORE NEWS: Peter Obi dey provoke Nigerians after Tinubu victory – APC

Also, di state Resident Electoral Commissioner, Mrs Elizabeth Agwu inside press conference on Friday, yarn say di commission dey ready, and say voting go start early.

Observation follow show say di BVAS dey work very well to capturing voters.

Voting don start for Ogun State for today governorship and House of Assembly elections.

Across different polling units for Ipokia Local Government Area of di State, e dey observed say di officials of di Independent National Electoral Commission (INEC) reach polling units as early as possible.

Few minutes after 8am, voters lined up for accreditation, wey happen simultaneously with voting.

Di exercise dey go on seamlessly at di moment.

You fit go see di full tori of di live updates from Governorship Elections today…READ MORE