fbpx
May 7, 2024

Peter Obi dey provoke Nigerians after Tinubu victory – APC

obi-dey-provoke-nigerians-apc

Di All Progressives Congress, APC, Presidential Campaign Council don accuse Peter Obi, di Labour Party, LP, presidential candidate, say hin dey make comment wey fit make Nigerians behave anyhow.

Inside statement on Friday, di ruling party knock di former Anambra governor. Dis na na because hin continue to condemn di victory of Presidential-elect, Bola Tinubu.

Bayo Onanuga, Director of Media and Publicity, APC PCC, bin respond to some statements wey Obi make during recent interviews on top television stations.

Onanuga yarn say Obi dey spread lies as if hin still dey campaign for di highest office for di land, weeks after INEC conclude di exercise and anounce winner.

FOR MORE NEWS: Lagos guber election: MC Oluomo Igbos threat na joke – Police

In reference to di LP flagbearer media rounds on top Arise TV and Channels TV, Onanuga yarn say Obi no do well with all those kain tok wey hin dey tok.

Di director complain say Obi criticize di poll, and hin describe am as di worst election for recent history and hin still tok say na robbery.

Na wetin hin tok for statement be dis:

“Obi came third, not even second, losing by 2.6 million votes to Sen. Bola Tinubu, APC candidate and the President-elect, despite getting outrageously padded votes from his ethnic South-East states.”.

In addition, di statement add say di APC PCC consider wetin Peter Obi tok for TV as prejudicial to di case wey hin filed for court and hin dey try make Nigerians behave anyhow.

You fit go read di full tori…READ MORE