fbpx
May 18, 2024

Hajj: Five Nigerians die for Saudi Arabia, 30 with mental challenges

hajj-confirm-five-deaths-for-Saudi-Arabia

Di National Hajj Commission of Nigeria don confirm di deaths of five Nigerian pilgrims wey dey participate for di ongoing Hajj for Saudi Arabia.

Na di head of NAHCON Hajj medical team, Usman Galadima, na hin tok dis tori on Saturday during di meeting of di commission for Makkah, Saudi Arabia. Also, hin add say 30 patients follow get mental health challenges.

He identify di delegates as two each from Osun and Kaduna states, while Plateau State record one.

Galadima reveal say di people with mental challenges still dey undergo treatment and dem dey expected to perform Hajj.

 

FOR MORE NEWS: Eid-el-Kabir: Katsina Gov’t don Declare 1-week Holiday For Schools

 

According to am, “na 30 of dem get mental health challenges.

Also, hin yarn say dem don dey manage dem for dia facilities. And dem get four psychiatrists on di team.

“We have been managing them and all of them would likely perform hajj because they are a bit stable now.” Na wetin hin tok be dat.

Another thing wey hin tok be say di 2023 Hajj clinic record two miscarriages and deliver one baby.

You fit go read di tori see as Hajj confirm five deaths…READ MORE