fbpx
December 22, 2024

Hauwa Indimi Dey Lament Over High Cost Of Tomato

hauwa-indimi-dey-lament-over-food-prices

Hauwa Indimi Yar’adua, di daughter of billionaire oil businessman Mohammed Indimi, dey lament as she express concern about growing prices of food for di Kontri.

Taking to her verified Instagram account, di cosmetologist share photo of a small basket of tomatoes wey she buy for Abuja for N8,000, and she tok say she neva get over am yet.

She caption di photo of di basket of tomatoes on Instagram with the words;

“I sent my staff to the market, and this is N8k tomatoes as of Monday. On Monday, July 3, she wrote, “I’m still not over it.”

 

FOR MORE NEWS: Actress, Funke Akindele and ex-husband, JJC skillz don fuel reconciliation rumor

 

According to di News Agency of Nigeria, due to di increased cost of tomatoes, plenty housewives for di Federal Capital Territory (FCT), Abuja, don stop to dey use dem for stew and other sauces.

In addition, some residents reveal say dem dey cook stew now with garden eggplants and carrots. They claimed say garden eggs, wey dey known as ‘ganyen gauta’ for Hausa, ‘igba’ in Yoruba, and ‘anyara’ for Igbo, fit blend as well as tomatoes with rice.

Others yarn say dem dey experiment with pumpkin, pawpaw, or traditional soups like white soup and palm fruit soup, wey dey known as banga, instead of tomato stew.

You fit go read di tori see as Hauwa Indimi dey lament over food prices…READ MORE