fbpx
May 14, 2024

JAMB Vs Mmesoma: Controversy dey hot over allege fake result

jamb-under-careful-investigation

Di controversy wey di Unified Tertiary Matriculation Examination, UTME bring about di result of Ejikeme Mmesoma again don put di Joint Admissions and Matriculation Board, JAMB under careful investigation.

While some don tok say Mmesoma dey guilty of forgery in line with JAMB position, plenty others think otherwise. Dem believe say di fault fit come from di board and na why dem need to investigate di matter well.

JAMB play crucial role in coordinating di admission process into tertiary institutions for Nigeria. Na di former Head of State, Olusegun Obasanjo na hin establish am on February 13, 1978.

In 2013, JAMB introduced Computer-Based Test (CBT) as a means to modernise di examination process and combat malpractice.

However, upon these efforts, di board don face plenty controversies.

 

FOR MORE NEWS: “Anambra student Ejikeme Mmesoma forge her UTME result” – JAMB spokesperson don reveal

 

One of the most infamous incidents happen in February 2018 when one JAMB official claim say snake swallow N36 millionfor dia office wey dey Makurdi, Benue State.

Di exam board official make di claims after some money wey come out from sale of scratch cards mysteriously disappear from di board office.

Also, di bold explanation say snake swallow di cash spark widespread scepticism and ridicule among Nigerians.

Critics view di incident as a reflection of deeper issues of financial mismanagement and accountability within government agencies.

You fit go read more of dis tori, JAMB dey under careful investigation now…READ MORE