fbpx
December 22, 2024

“Keep it”- Sina Rambo wife don put up wedding ring for giveaway, she announce divorce

heidi-korth-confirm-legal-separation

Heidi Korth, di ex-wife of Davido cousin Sina Rambo, recently confirm inside post say dia separation dey legal now.

Also, Heidi, Sina Rambo ex-wife, don declare say she go give away her diamond wedding ring without charge to any couple. And she reveal say dem dey officially divorced.

According to Heidi, she make di decision to donate her diamond wedding band to any couple wey wan marry but never buy ring.

She ask say make anybody wey dey interested email her a copy of dia wedding invitation so she go confirm say dem wan do wedding.

Remember how Heidi reveal say in December last year her marriage bin don scatter and she give di reason why.

 

FOR MORE NEWS: I don come back to restructure APC for Osun – Aregbesola

 

Na wetin she yarn be dis;
“This is my wedding ring, since I am now officially divorced, I want to give it out to someone who is getting married soon It is actually a diamond ring, just hit me up, send a picture of your wedding invite and I will send it to you.”

However, netizens don enter di comment section to claim say her ring go bring bad luck to anybody wey take am.

Ladyque_1 said: “You wan give person ring from marriage wey no work. I feel it’s bad luck to use such ring.”

_Sharonsharry reacted: “No collect am oooo…. Like why should you give out a wedding ring that didn’t work out to someone else, abeg carry am go museum.”

You fit go read di tori as Heidi Korth confirm separation…READ MORE