fbpx
May 15, 2024

I don come back to restructure APC for Osun – Aregbesola

aregbesola-to-restructure-apc

A former Minister of Interior, Rauf Aregbesola don tok say hin don come back to restructure di All Progressives Congress, APC for Osun State.

Also, di former two term governor of Osun State wey maintain say hin no offend anybody follow ask for forgiveness from pipo wey dey vex for am.

Aregbesola tok dis matter on Wednesday as residents of di state and members of di Osun APC welcome am back to di state.

For di event wey dem hold for Nelson Mandela Freedom Park, Osogbo, Aregbesola explain say e dey unfortunate say ‘some pipo’ mismanage di affairs of di APC and dem do am anyhow.

Also, hin yarn say in 2019, hin bin call for di unity of di party with warning say failure to unite different interest groups for di party no go produce any good result.

 

FOR MORE NEWS: Corp member dey find advise as she receive N330K allawee instead of N33K

 

Di former Minister later pay visits to di Ataoja of Osogbo land, Oba Jimoh Olanipekun Oyetunji and Owa Obokun of Ijesaland, Oba Gabriel Adekunle Aromalaran, where hin present hin score cards.

Before di 2022 gubernatorial election for Osun State, Osun APC bin dey fall apart as former Governor Adegboyega Oyetola disagree with hin predecessor, Rauf Aregbesola.

You fit go read di tori as Aregbesola tok say hin don come back to restructure APC…READ MORE