fbpx
April 19, 2024

Hit-and-run driver don kill ex-Lagos governor pikin

0

Di deputy managing director and co-founder of Vetiva Capital Management, Olaolu Mudasiru, don kpai after one unidentified driver hit am.

According to tori Mudasiru bin kpai on Sunday morning for one hit-and-run accident while hin dey ride cycle with two other pipol around Bourdilion road for Ikoyi area of Lagos State.

U  FIT ALSO READ Pipol dey Panic, as soldiers invade community, burn down houses for Ebonyi

Di Vetiva co-founder na di first son of Gbolahan Mudasiru, a former military governor of Lagos state, wey bin kpai for 2003.

Di Lagos Police Public Relations Officer, Benjamin Hundeyin, bin confirm di incident to tori pipol. hin tell dem say dey never arrest anybody wey dey in connection to di accident.

Mudasiru na investment banker with a lot of experience for stockbroking, asset management and other aspects of investment wey concern banking activities.

Hin bin get MSc. for International Securities, Investments and Banking from di ICMA Centre of The University of Reading, UK, an M.B; B.S. Degree from di College of Medicine, University of Lagos, Nigeria, and hin bi alumnai of di Stanford University Graduate School of Business.

Mudasiru na Member of di London Stock Exchange, an Associate of di Chartered Institute of Stockbrokers, Nigeria as well as being a member of di Medical & Dental Council of Nigeria.

To read di full tori CLICKHERE
.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *