fbpx
April 19, 2024

Pipol dey Panic, as soldiers invade community, burn down houses for Ebonyi

0

Troops of di Nigerian Army according to report don invade Obeagu Community for Ishielu Local Government Area of Ebonyi State.

Some community leaders on Monday morning, tell tori pipol say di troops invade di community around 5am, con dey shoot anyhow and still burn down some houses.

U FIT ALSO READ Insecurity: bandits don kill Zamfara monarch

Di soldiers bin enter di community with 10 Hilux vehicles and seven armored tanks with over 100 military personnel.

Di reason why di military invade di community never clear to anybody but, according to report no bodi don kpai for di incident so far. But tori tok say na Only one woman bin woundjor by stray bullet.

Confirming di invasion, di community leader and immediate past councillor of di community tok say, “ dem bin wake up dis morning with di sound of military gunshot everywhere. As hin dey tok so everybody don run for dia dear life. Base on say di Soldiers dey shoot gun for all di communities.

Hin tok say,“ hin bin dey for church early dis morning around 5:30am wen di military vehicles numbering over 30 including armored tanks enrer into di community. Shortly after dey start to shoot anyhow.

Infacr None of di popol for di community show for church dis morning at all,like dis like dis hin dey answer dis call inside one bush na wetin,” Ogbuabor tell tori pipol bi dat. ”

Tori pipol tok say according to report di invading soldiers bin dey ask some women and old popol wey dey arrest say, where bi di camp of di Indigenous People of Biafra “IPOB” bin located for di community.

.Meanwhile, dem bin try all efforts to get through to Nigerian Army but di Deputy Director Army Public Relations, 82DV, Major Jonathan Unuakhalu, no answer hin calls or respond to text messages wey dem send to hin phone

To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *