fbpx
March 28, 2024

Hoodlums attack Atiku campaign convoy for Borno

0
Atiku-Borno-convoy

OUTRAGE na di word wey we fit use describe this one as yesterday plenty supporters of Peoples Democratic Party, PDP, Presidential Candidate, Alhaji Atiku Abubakar, get serious injury after some hoodlums attack dia convoy for Maiduguri, di Borno State capital.

Di information wey come out be say dem attack Atiku convoy just as hin comot go di Palace of di Shehu of Borno to Ramat Square, venue of di presidential rally.

As di matter be so, all di pipo wey get injury na hin dem don rush go hospitals for di state capital.

YOU GO LIKE READ: How to Educate Yourself on a New Subject

Some minutes before di presidential candidate climb stage say make hin talk, di spokesperson of Atiku campaign council, Dino Melaye, announce say some hoodlums don attack di convoy of di campaign council and about 174 supporters get serious injury for di  process, while over 100 vehicles for di convoy don dey damaged.

This tori dey inside Vanguard, you fit go read di remaining… READ MORE

For more news: Only Tinubu fit take Nigerians to di promise land – Yusuf Idris

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *