I dey wake up see credit alerts everyday– Iyanya
Nigerian Afrobeats singer, Iyanya don reveal say 2022 na hin most successful year since he return to mainstream music.
Di Kukere hit maker yarn say dem book am for more than 20 shows for December alone and di last time were hin busy like this na December 2017.
Iyanya use hin Twitter page talk about how hin perform for only three shows last year because he bin on fade from di spotlight.
FOR MORE NEWS: “Dear mainlanders, how una dey go work for Island everyday?” – Actress, Mary Remmy Njoku dey ask Lagos residents
According to di Project Fame winner, em pay am for one of di shows he beg to perform for di other two of di events.
Hin express deep thanks to God as he mention say hin dey wakes everyday see credit alerts from people wey book am for events.
Iyanya show appreciation to hin fans as dem support and stream hin music.
He promise say he go make 2023 a better year for everybody wey go stand by am through hin downs and ups for 2022.
You fit go read more of this tori…READ MORE