I don comot for engagement palava – Empress Njamah
Nollywood actress Empress Njamah don come out clear everybody di rumour wey dey go on social media say she don dey engaged.
Njamah bin accuse her ‘fiance’ of physically assaulting her, for one Livestream video through her business Instagram.
U FIT ALSO READ “Hin dey Love Hard and Genuinely”: BBNaija Frodd don dey Engaged
Di actress tok say di engagement video on her personal Instagram page bin happun out of her own will base on say her fiance don scam her, beat her, and she been held hostage by di man, wey she tell everybody say he come from Liberia.
She tok say, “ dat guy no bi persin wey pipol fot call human being at all, She tok say di guy just dey pretend like say hin na beta human being, hin just wan use style style get marry to her.
Njamah tok say she don dey speak to di guy for months on phone, she even speak to some pipol wey di guy introduce to her as hin relatives. Not knowing say everything na scam.
Although her body no dey alright like dat and she dey try all means to keep am away from di press make di whole public no go know wetin she dey face but dis guy just come from no where into her life con dey promise her heaven and earth say hin go stand by her
She tok say di death of her friend broke her down so bad sote she no even fit function for anything at all. So and na dis opportunity di guy take enter her life. hin con yo say hin go stay by her, not knowing say di guy wan gather toolz, materials wey he go take blackmail her.
Njamah tok say after di guy get access to her naked videos, hin change con dey misbehave anyhow.con still dey blackmailed her with di naked videos of hers. She tok say, “ Di guy wreck her, collect everything wey she don ever work for.
Njamah tok say “ no bi her dey handle her page again #empressnjamah, she tok say make pipol go to dat page and see di video wey di guy post, Seh she go fit post something like dat ? No. She tok say both di recording and posting of di engagement video dey against her will.”
To read di full tori CLICKHERE