fbpx
April 26, 2024

Ikpeazu charge Enyimba make hin win Nigeria Super 6 League

ikpeazu-don-congratulate-enyimba

Abia State Governor, Okezie Ikpeazu don congratulate Enyimba International Football Club of Aba for qualifying for Nigeria Professional Football League, NFPL, Super Six competition.

Di Governor charge di team make dem complete di performance by defeating di other five teams for di competition and emerge di champions.

Ikpeazu give di commendation inside message signed by hin Chief Press Secretary, Onyebuchi Ememanka.

He describe Enyimba as di pride of Abia State and Nigeria and hin encouraged dem say make dem make di State proud once again by beating dia  final opponents.

 

FOR MORE NEWS: Ortom vows to support Tinubu after hin leave office

 

Enyimba qualify for di Super Six competition after hin finish as third for di Group A NPFL table with 32 points behind Bendel Insurance and Remo Stars wey finish with 34 points and 33 points respectively.

For di Group B table, Rivers United, Lobi Stars and Sunshine follow qualify to compete for di Super Six trophy.

Di six teams go face dem sef for league format where di team with di highest points go dey crowned as winners.

You fit go read di tori as Ikpeazu don congratulate Enyimba …READ MORE