fbpx
April 29, 2024

INEC ask police make dem look for Adamawa REC

inec-want-investigation-on-Yunusa-Ari

Di Independent National Electoral Commission (INEC) don write to di Nigeria Police Force (NPF). INEC want investigation into di action of suspended Adamawa Resident Electoral Commissioner (REC) Hudu Yunusa Ari for di state governorship election.

Remember say Yunusa-Ari bin declare di All Progressives Congress (APC) candidate Aisha ‘Binani’ Dahiru as di winner of di supplementary poll even when di collation of results still dey go on. Dis na decision wey INEC nullify.

Also, di police don confirm say dem don receive INEC letter demanding Yunusa-Ari’s search. Di Police Force spokesman Olumuyiwa Adejobi follow tok for inside statement;

According to di Nigeria Police Force letter wey dem receive on 18th April 2023 from di Independent National Electoral Commission (INEC), di letter tok about di claim of di improper actions of one Barr. Hudu Yunusa-Ari, di Adamawa State Resident Electoral Commissioner (REC), during di recently concluded supplementary elections and, di letter dey call on di Police to investigate and possibly prosecute di REC for hin actions.

FOR MORE NEWS: Sudan conflict: Govt want Egypt support to rescue 5,500 Nigerians by road

Di Inspector-General of Police, IGP Usman Alkali Baba, CFR, don direct investigative team to work in collaboration with di INEC to take action on di contents of di letter.

Also, as di Inspector-General of Police dey express di commitment of di NPF to uphold democratic values, hi assure Nigerians and di international community, say di Police go leave no stone unturned in unraveling di remote causes of di harmful conduct of di REC as well as ensure say all persons weygethand for di matter enter book.

You fit go read di tori as INEC want investigation on Adamawa REC…READ MORE