fbpx
December 22, 2024

No panic, no plans to increase fuel pump price to N700 – IPMAN

ipman-deny-pump-price-increase-allegation

Di Independent Petroleum Marketers Association of Nigeria IPMAN don deny di alleged plan by di association to increase pump price of Premium Motor Spirit (PMS), also known as petrol, to N700 per litre nationwide.

NAN report say di Chairman of IPMAN Southwest Zone, Dele Tajudeen, make di clarification inside interview for Ibadan on Friday.

He advice Nigerians make dem no mind di speculation and make dem no engage in panic buying.

Also, Tajudeen stress say di product price no go pass di amount wey dem dey sell am now.

And, hin commend President Bola Tinubu as hin remove di subsidy on petrol, also, hin add say e dey long overdue.

 

FOR MORE NEWS: “N100 per Unit”: Nigerians Make Last-Minute Bulk Electricity Purchase Ahead of 40% Tariff Increase

 

He yarn say di slight increase in pump price na because of di transportation cost and say Nigerians need to calm down as di commodity no go dey out of reach for di masses.

In addition, hin yarn say if we look di price from NNPC retail limited, wey be integral part of NNPC limited, dem get more advantages than independent marketers and major marketers.

Meanwhile, a coalition of Civil Society Organisations (CSOs) don vowed to resist di alleged planned increase in the pump price of petrol.

You fit go read di tori see as IPMAN deny pump price increase allegation…READ MORE