fbpx
May 4, 2024

“N100 per Unit”: Nigerians Make Last-Minute Bulk Electricity Purchase Ahead of 40% Tariff Increase

nigerians-buy-units-in-bulk-ahead-of-increase-in-tarrif

Ahead of di planned electricity tariff increase, plenty Nigerians don decide to buy units in bulk at di current rate. Dis na decision wey dem hope say go help them save costs when di new electricity tariff dey implemented.

According to report, earlier di Electricity Distribution Companies(DisCos) wey dey responsible for electricity supply dey prepare to increase tariffs by 40% from Saturday, July 1, 2023.

Although no official confirmation yet, di development follow di expected discontinuation of all forms of subsidy for di electricity and energy sectors within di Kontri.

 

FOR MORE NEWS: Gov Otti don suspend Head of Service, permanent secretaries

 

For instance, a message from Abuja Electricity Distribution Company(AEDC) to dia customers,according to report from BusinessDay, yarn say: “Effective July 1st, 2023, make pipo dey informed of di upward review of electricity tariff and na because of di fluctuating exchange rate.

Following public dissatisfaction, AEDC dey forced to abandon dia notice and dem apologise to Nigerians. However, despite di denial and apology, e appear say di new electricity tariff go dey effective from July 1, 2023. Banks’ don dey message dia customers Commercial banks and fintech companies sef don already start to send messages to dia customers on di new electricity tariff.

According to report,  Nigerians for  Band B or C (12-20 hours/day), di new tariff could fit go as high as N100 per unit (kWh). While customers for Band A (20 hours or more per day) go dey charged N120 and N140 per unit. DisCos dey awaiting approval from the Nigerian Electricity Regulatory Commission (NERC) to implement di coming changes.

You fit go read di tori see why Nigerians don start to buy units in bulk…READ MORE