fbpx
April 24, 2024

Katakata burst on top Miyetti Allah’s comments on Peter Obi

0

Coalition of Fulbe Professionals in Africa, on Monday, don yarn say dem no join hand for wetin one Alhaji Alhasan Salah, who be National Secretary of Miyetti Allah Kautal Hore talk on top Peter Obi, say the Miyetti Allah no go vote for 2023 presidential candidate of Labour Party. The group talk say, wetin him dey yarn for mouth nah rubbish wey no suppose dey komot for elders mouth. The group reason am say, no be him dey talk, nah wetin dem sen, say am make him talk e dey yarn for mouth.

The organization called on Nigerians say, make dem no dey reason wetin Alhaji Alhasan Salah talk for mouth, say no be him for tell the Fulani groups whom dem go vote for and who dem no go vote for 2023 Presidential election.  The full dey inside punch online, click here to read am

Alhaji Alhasan, wey grant and interview on top newspaper don yarn say for the general election wey dey come so, the Fulani nation would not support Peter Obi at all at all, say him nah person whey dem no fit trust because say him too dey tribalistic. He had join am say, Peter Obi no like people wey come from north and their brother wey be Fulani’s at all. Read the full interview inside punch online READ MORE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *