fbpx
May 3, 2024

Kcee win 11.7 million naira bet as Super Eagles knack Ivory Coast for AFCON 2023

kcee-hit-jackpot-win-11-7-million-naira-bet

Naija musician and songwriter, Kingsley Chinweike Okonkwo, wey people dey call Kcee, talk say e don hit jackpot with bet big money – 11.7 million naira bet, as Super Eagles carry victory yankee Ivory Coast for AFCON 2023.

Inside one TikTok video, Kcee show im happiness with fellow musician Teni after Super Eagles waka enta final with 1-0 win for di tournament. William Troost-Ekong, Super Eagles captain, na him score di crucial goal from penalty spot for second half.

Fans and followers join di celebration, drop comments for di post.

 

FOR MORE NEWS: Lady yan say Warri Pikin no dey talk true about di side effects of her surgery.

 

See some reactions below:

SON7: “If you get money, you go enjoy bet, no be us wey dey use #200 pursue 2 million.”

user6092095442037: “As we dey celebrate say my papa win 20 trillion before, we know my mama run come say she win 40 trillion.”

Igwefresh Yusuff: “Put 3 million and win 11.7, na who get money get bet, ma kala.”

IfeRoyal: “Na the same bet go still collect the 11.7 million later on gradually.”

ZonaBobski: “Na so dem give our youth bet to forget di problem wey dey face Naija.”

Xiedy: “To everyone wey read dis, I be musician and I wish make you follow me 🙏 🥺 E fit mean plenty.”

Malcolm: “I win 55 zillion with this Naija game, if you argue, I go post screenshot.”

Tommy: “I go stake game with 15k, I go wan die.”

Na so e be for di matter, as Kcee dey shine teeth with big win, and fans dey yarn dia mind for di mata.

You fit go read di tori see how Kcee bet hit jackpot…READ MORE