fbpx
May 18, 2024

“Dem call Child protective services again to carry my pikin” – Dancer Korra Obidi dey vex

korra-lambast-unnamed-persons

US-based Nigerian dancer and singer, Korra Obidi, don take to social media to lambast unnamed persons wey report her to Child Protective Service (CPS).

During recent Instagram live session, di mother of two reveal say CPS officials recently visit her house again following reports wey some people make.

She express frustration say despite her decision to stop to dey post her children on top social media, some pipo still dey report her give child protective services in an attempt to portray her as mama wey bad.

 

FOR MORE NEWS: How person wan take define wickedness – Ugezu Ugezu lampoon Nigerian chefs wey dey challenge Hilda unofficial record

 

She claim say dis time dem accuse her say she lock her children up and say she dey physically abuse dem.

Korra wey dey vex express her confusion about wetin she don do to these people, as dem dey determined to ensure say dem collect her children from her.

On top di matter, Korra lambast di unnamed persons wey dey responsible and she lay curses on dem.

You fit go read di tori…READ MORE