fbpx
May 18, 2024

Make nobody force you vote against your conscience – Buhari to Nigerians

President-Buhari

President Muhammadu Buhari don advise Nigerians make dem no fear to say dia opinions for di 2023 general elections.

Di president wey talk through di minister of Communication and Digital Economy, Professor Isah Pantani yarn say nobody get di right to force another person to vote against his or her conscience.

He make di statement during di closing ceremony of di 37th National Qur’anic Recitation competition for Gusau, di State capital, and hin commend di State government for sponsoring di program.

FOR MORE NEWS: I go remove petrol subsidy, Tinubu make vow for luncheon

Di President task di politicians and leaders make dem justify dia positions by being fair to dia subjects, hin stress say if Muslims and Christians fit read Qur’an and Bible, nothing fit carry peace comot  from the country.

For hin speech, Governor Bello Mohammed Matawalle say di insecurity situation for di state inform hin decision to host di competition, hoping saay e go make great  impact on di lives of di people.

You go like go read di full tori...READ MORE