fbpx
March 29, 2024

Make una Return home,Abia state government beg di pipol of Amangwu

0

Abia State Government don donate cash, bags of rice and other food items to di runaway pipol of Amangwu community for Ohafia council area.

Di government don ask di pipol of Amangwu community to return home as government of Abia don calm di gbege wen bi sele for di area.

U FIT ALSO READ JUST-IN: Soldier wey don high don kpai Army General for Lagos

Di pipol of Amangwu community run comot for di area sake of say soldiers invade dia community searching for dia missing colleagues.

Over 50 houses na hin those soldiers burn, lot of lives and properties also lost for di matter and di pipol of di community con run go hide for neighbouring communities.

Di Deputy Governor of Abia state, Sir Ude Oko Chukwu wen present di items during a visit to di IDP, camp for Okpocha square, Amaekpu community inside Ohafia,tok say di government dey sorry for wetin happun and make di pipol no vex.

Hin tok say,Dr.Okezie Ikpeazu’s led administration don readi to take full responsibility of everything make dem no worry.

Ude don beg di pipol of di community to come back home,hin tok say di 14 Brigade, Ohafia, don promise to protect dem and dat kind thing no go ever happun again.

Hin tok say di state government thank di entire Amaekpu Community as well as sister communities of Elu and Ebem Ohafia for all dia effort in taking care of di pipol of Amangwu dem dey grateful well well..

To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *