fbpx
December 22, 2024

Man abduct, rape 17-year-old girl in Lagos

Man-abduct-and-rape-teenager-for-Lagos

One Ogudu Magistrate Court for Lagos on Monday, April 17, give order say make dem keep one 27-year-old man, Idris Umai wey allegedly abduct and rape  teenager  for inside correctional centre.

Umai, wey dey stay for Mile 12, Ketu for Lagos dey charged with abduction and defilement.

Earlier, di Prosecution Counsel, Insp Donjour Perezi yarn say Umai commit di offence on Oct. 2022 for Sanusi Estate, Mile 12, Lagos, NAN reports.

Perezi claim say Umai carry di 17-year-old girl close to her house, on her way back from school.

 

‘’The defendant conspired with one Faziya Abubakar, Mohammed Motali, Abubakar Mohammed, Amina Aminu and Aisha Ibrahim all of Mile 12 to abduct the girl,” Na wetin dem tok be dat.

 

FOR MORE NEWS: “To get help for Nollywood dey hard” – Joseph Momodu

 

Hin tok say di offence, violate di provisions of sections 173 and 268 of di Criminal Law of Lagos 2015.

Di Magistrate, Mrs M.O Tanimola, no accept di appeal of Umai, pending legal advice from di state Director of Public Prosecutions.

She adjourn di case until May 5, for mention.

You fit go read di tori of di Man wey abduct and rape teenager for Lagos…READ MORE