fbpx
December 22, 2024

“JAMB send me text message say I score 249” — Mmesoma

Mmesoma-agree-say-her-score-na-249

Mmesoma Ejikeme, di Anambra student wey dey accused of manually inflating her 2023 UTME result by di Joint Admissions and Matriculation Board on Wednesday confirm say she receive an automated text message from JAMB wey show say her score na 249.

Mmesoma tok dis matter during interview with Sunrise Daily on top Channels Television wey dey monitored by The PUNCH.

JAMB spokesman, Fabian Benjamin, bin earlier reveal say di candidate bin send series of messages to di board automated telecoms system, including di results wey show an aggregate of 362.

Responding, Mmesoma tok say na only SMS she send to JAMB an na through di support system:

 

“That’s the only SMS I sent there.”

 

FOR MORE NEWS: JAMB Vs Mmesoma: Controversy dey hot over allege fake result

 

Also, dem ask her if she get any feedback, but she tok say she no recieve reply. She yarn say if dem check dia JAMB Support System, dem go see say she send text message and dem no reply.

On di claim say she use Airtel line, Mmesoma repliy “Yes,” but she add say no be through USSD code.

She yarn say di one wey she check through di USSD code na di one of 360 wey she see.

Responding to di claim say di feedback from JAMB show her score as 249, she agree.

“Yes,” she said. “After all was said and done, I now saw that I got 249. I sent them a text message there to know what really happened — the JAMB Support System. If they go to their system, they will see it there.”

Dis 19-year-old Anambra student dey insid news since following allegations of UTME score forgery.

You fit go read di tori as Mmesoma agree say her score na 249…READ MORE