fbpx
September 28, 2024

“I dey suffer for my marriage, Jasmine na my husband girlfriend no be daughter” – Mr. Ibu wife dey cry out for help

mr-ibu-wife-dey-cry-for-help-Jasmine-no-be-hin-pikin-

Stellamaris Okafor, wife of veteran Nollywood actor, John Okafor, wey dey popularly known as Mr. Ibu, don cry out for help over fidelity issues with her husband and one lady wey dey identified as Jasmine, and di lady dey claim to be hin daughter.

Remember say last year Jasmine bin go viral for TikTok, and she bin dey parade Mr. Ibu as her papa and she also make plenty videos with am.

Di actor wife go meet another Instagram blog, na for there she open up about her marriage struggles and Jasmine plan to sell her husband house wey worth over N65 million.

Stella claim say she dey suffer for her marriage because her husband abandon her and dia children since last year to pursue hin relationship with Jasmine.

She yarn say di lady wey dey pose as Jasmine Okoafor na Chioma Florence Okekeagukwu, from Imo State, and she no dey related to her husband wey come from Enugu State.

FOR MORE NEWS: Netizens don reacts as Mr Ibu wear woman cloth dey do dance battle with hin daughter

According to di actor wife, Mr. Ibu bin suffer from dementia (memory loss), and Jasmine take advantage of her husband illness to achieve her recognition.

Mr. Ibu wife allege say Jasmine na di actor manager and na she dey receive all di money wey dey related to hin company and performance.

She still tok say anytime wey she wan follow her husband tok or she wan ak for money,  she dey always go through Jasmine.

She mention say in addition to handling all of Mr Ibu’s social media accounts, di couple dey in love relationship.

Mr. Ibu wife yarn say dia children no dey go school because money no dey, as Jasmine, di actor’s bank account manager, no gree approve di payment of dia school fees.

You fit go read di full tori…READ MORE