fbpx
June 26, 2024

BREAKING: CBN don extend di old naira notes deadline

Naira-Notes-shortage-experts

Di Central Bank of Nigeria don extend di deadline for di swapping of old naira notes with di redesigned notes till February 10, 2023.

This update come from di CBN, and dem release on Sunday.

According to di apex bank,  dem yarn say na only 10-day extension of the deadline from January 31, 2023, to February 10, 2023, dem go give to allow for di collection of more old naira  notes.”

Na di CBN governor, Godwin Emefiele na hin dend di information.

Additionally, hin note am say Nigerians go still fit deposit dia old notes directly with di CBN until February 17, 2023. Hin describe di extra days as “grace period.”

FOR MORE NEWS: Naira notes redesign: ” Di target na elites wey dey hoard illicit funds, no be common man – Presidency

Although, pressure bin don dey come  from many Nigerians and groups concerning di initial January 31 deadline for di validity of di old notes. This na because of di scarcity of di newly designed 200, 500, and 1000 naira notes for di country.

Emefiele yarn say dem don get approval from Mr President following di 10-day extension of the deadline from January 31, 2023, to February 10, 2023. In other words, dem feel say as dem extend di deadline, give grace period, e go allow collection of more old naira notes wey some Nigerians still dey hold. This strategy go allow dem achieve more success in cash swap for rural communities.

More information wey dem give be say dia CBN staff dey on mass mobilisation and dem dey monitor together with officials of di Economic and Financial Crimes Commission and di Independent Corrupt Practices and other Related Offences Commission so that dem go achieve these goals.
You fit go read di full tori…READ MORE