fbpx
June 17, 2024

Naira notes redesign: ” Di target na elites wey dey hoard illicit funds, no be common man – Presidency

presidency-naira-redesign-target-na-elitei-no-be-common-man

Di presidency don come out for di first time explain di idea behind di redesign of some naira notes wey dem dey do in a hurry, dem tok say di target na to frustrating some elite Nigerians wey dey hoard illicit cash.

Senior Special Assistant on Media and Publicity to di President, Garba Shehu, for hin statement on Saturday, yarn say no be wetin pipo dey think.  Hin yarn say di hurried redesign of some naira no dey targeted at di common man for di  streets.

Remember say since di 31st January deadline wey Central Bank of Nigeria give, e dey report say long queues of pipo dey for bank. Dem dey wait for hours make e reach dia turn to deposit old notes and to collect new ones.

FOR MORE NEWS: “I join Nigerian Army because of pressure to marry” — Buhari

According to di Shehu on behalf of di presidency, di redesign of naira currency dey target pipo wey dey hoard illicit funds and no be di common man. Additionally, dem yarn say e don became necessary to prevent counterfeits, corruption, and terrorist financing. On top that one, e go stabilize and strengthen di economy on the long run.

Even so, Federal Government, acknowledge di fact sat di poorest section of society dey facing untold hardship as dem dey always keep cash for house because of different expenses.

Hin continue as hin tok say a number of initiatives by di Central Bank and all commercial banks dey come to speed up distribution of di new notes.

You fit go read di full tori…READ MORE