fbpx
December 22, 2024

Naira redesign: Kidnapping and banditry don reduce – Emefiele

naira-redesign-kidnapping-don-reduce-emefiele

Godwin Emefiele, di Central Bank of Nigeria (CBN) Governor, on Tuesday, beg di lawmakers and Nigerians say make dem demonstrate understanding, hin insist say with di Naira redesign, di apex bank dey do everything wey dem fit do to fight di incidence of insecurity, Kidnapping and banditry for Nigeria.

Also, Emefiele claim say di incident of kidnapping and banditry don reduce because of di Naira redesign.

Hin tok this one during hin call for Abuja before di House of Representatives. ’Di committee bin gather to address di issue on di scarcity and di deadline for di old Naira notes.

Emefiele advise all di pipo wey dey affected because of di change nd policy, say make dem bear with di apex bank.

FOR MORE NEW: Gbajabiamila Wan Sign Warrant of Arrest against Emefiele

As hin tok that one, hin advise Nigerians say make dem comply with all directives.

In addition, hin confirm say di beginning stage of this change fit no dey smooth, but all na to  make the Nigerian economy better and stronger.

Di redesigned naira notes and CBN cashless policy don moderate inflation for di country and e don reduce di activities of kidnappers and bandits.

“Inflation dey  moderate hin sef, di exchange rate dey  stable, and we dey hope say di naira go dey be stronger.”

All these things na wetin Godwin Emefiele tok.

You fit go read di full tori…READ MORE