fbpx
May 18, 2024

Gbajabiamila Wan Sign Warrant of Arrest against Emefiele

gbajabiamila-sign-warrant-arrest-againt-Emefiele

Femi Gbajabiamila, di Speaker of di House of Representatives, dey expected to sign di warrant of arrest against di Governor of Central Bank of Nigeria (CBN), Godwin Emefiele during plenary on Tuesday.

Na during di interview with tribune by di Chairman of di House Committee on Media and Public Affairs, Benjamin Kalu., na hin dem confirm this matter say Gbajabiamila wan sign warrant arrest against Emefiele.

Kalu announce say di majority leader for di house, Alhassan Ado-Doguwa bin meet with President Muhammadu Buhari. For there, brief am on di need for Emefiele to appear before di house over di new cash withdrawal limit and cash swap policy.

FOR MORE NEWS: PDP Crisis: Wike Don Finally Drops When His Hammer Go Land on Ayu and Other Party Leaders Head

Kalu mention say e dem important make dem compel am to brief di Parliament in line with Section 8 subsection 4 of di CBN Act.

Hin tok ay di leader of di house wey be di chairman of di this Ad-hoc committee on change fo naira notes dey follow insist say di extension by 10 DAYS no dey enough,.

In addition, in line with di  CBN act, hin yarn say dem need to comply with di invitation and convince di house on why dem wan amend di policyfor this critical moment and why dem no contact di house at all.

You fit go read di full tori…READ MORE